Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 13:43 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

43 Den, God pipol go shine like sun inside dia Papa Kingdom. Anybody wey get ear, make e hear!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 13:43
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen ever Israel pipol si Moses face dey shine, Moses go kover en face until e won go meet and tok to God.


But wise pipol go shine like lite for di sky. Doz wey tish pipol di rite tin, go shine like star forever and ever.


“Den di king go tell di pipol wey dey en rite hand, ‘Make una kom, una wey my Papa don bless and make una inherit di kingdom wey God prepare for una before di world start.


I dey naked and una give mi klot wear, wen I nor well, una kare for mi, wen I bin dey prison, una kom visit mi.’


I tell una, from naw go, I nor go drink dis wine until di day wey I go drink di new wine with una for my Papa kingdom.”


If anybody get ear, make e hear wetin I dey tok!”


“Make una nor fear, una wey bi small sheep, bikos una Papa go happy to give una di kingdom.


So, I give una pawa to rule, just as my Papa don give mi.


So my friends, make una dey strong and nor let anytin shake una. Make una always dey do God work, bikos una know sey, evritin wey una do for God, get gain.


My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ