33 Jesus still tell dem anoda parabol: “God Kingdom bi like yist wey one woman take bake bread. E mix am with plenty flower and di small yist kon make di bread raiz well-well.”
So Amnon do like sey e nor well kon go liedan for bed. Wen David go si am, e kon tell di king sey, “Abeg! Make yu tell Tamar make e kom bake kake for here make I dey si am, den serve mi by ensef.”
E dey kut evry branches wey nor dey bear fruit for my body komot and e dey ripair evry branch for my body wey dey bear fruit, so dat e go bear more fruit.
But make una grow inside di grace wey awa Oga God and Savior, Jesus Christ give una, so dat una go know am more-more. Make glory bi en own, naw and forever! Amen.
Den Gideon rush go house go kook one yong goat den e use flower bake bread wey nor get yist. E put di meat for basket kon put di bread for pot, den e karry am go give di angel wey dey under di oak tree.
So di woman stay with en pikin until e kon big. Wen Hannah don train am rish, e kon karry am with three melu, one bag of flower and one kontaina of wine, go God house for Shiloh.