Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 13:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 But for nite wen evribody dey sleep, di enemy kon go plant grass join dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 13:25
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E stand up for nite and wen e si sey I dey sleep, e karry my pikin go en bed kon put en pikin wey don die for my bed.


Jesus kon tell en disciples anoda parabol, “God Kingdom bi like wen pesin plant good seed for en land.


Wen di seeds grow kon dey bear fruit, di grass grow too.


“So di savants tell dia oga sey, ‘Nor bi good seed wi plant for yor farm? Na where di grass from kom?’


“But di oga tell dem, ‘No, if una go rut di grass komot, una fit make mistake rut some for di good seeds too.


Make di good seeds and di grass grow togeda until harvest. Dat time, I go tell di pipol wey dey harvest sey, “Make una first rut all di grass, tie and burn dem, den gada di good seeds put inside my store.” ’ ”


and di enemy wey plant dem, na di devil. Di harvest na di last days and di harvest workers, na di angels for heaven.


E kon happen sey di man wey won marry, nor kwik kom, so all di virgins kon sleep.


Dem diskuss dis matter, bikos of di fake brodas with dia wayo wey dem take dey spy di freedom wey Christ give us, so dat dem go fit make us dia slave.


Make una make sure sey nobody turn back from God grace and make nobody get bad belle and kause trobol wey go make pipol sin.


Make una shine una eye well-well, bikos devil wey bi una enemy, bi like hongry lion wey dey shaut and dey find who e go chop.


As fake profets dey among di pipol before, na so fake tishas go dey among una too. Dis fake tishas go tish lie-lie tins wey fit distroy pesin and dem go sey dem nor know di Masta. Like dis, dem go distroy demsef.


Dis dragon na di old snake wey bi di devil or Satan, wey dey deceive di world. Dem trow am kom down from heaven with en angels.


E deceive di pipol for dis eart with di mirakles wey e dey do for di beast front and e tell di pipol sey, make dem make one image for di beast (wey wound before, but still dey alive).


But dis na wetin I get against yu: yu allow dat woman, Jezebel, make e dey do wetin e like. Dat woman wey koll ensef profet and di tins wey e dey tish dey make my savants sin, bikos dem dey sleep with who nor bi dia husband or wife and dem dey chop juju food.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ