Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 13:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 Jesus kon tell en disciples anoda parabol, “God Kingdom bi like wen pesin plant good seed for en land.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 13:24
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Bikos E dey won tish us word for word, line by line and lesin by lesin, do am like dis or do am like dat.”


So God word nor make sense at-all to dem and na dis go make dem fall wen dem try to waka. Yes! Dem go fall for trap kon wound and dia enemies go karry dem go as prisonas.


“Man pikin, go tell Israel pipol dis parabol;


‘Wen pesin hear God word and e nor undastand am, di devil go kom tif di word wey dem plant for en heart, dis na di seed wey fall for road.


But for nite wen evribody dey sleep, di enemy kon go plant grass join dem.


Jesus kon tell dem anoda parabol: “God Kingdom bi like mustard seed wey one man plant for en farm.


Jesus still tell dem anoda parabol: “God Kingdom bi like yist wey one woman take bake bread. E mix am with plenty flower and di small yist kon make di bread raiz well-well.”


Jesus ansa dem, “Pesin wey plant good seed na God Pikin;


Again, God Kingdom bi like net for sea wey katch difren-difren fish.


“God Kingdom bi like wen one king wey won know how en savants dey manage en business.


“God Kingdom bi like wen pesin komot for early morning go hire pipol wey go work for en farm.


“Make una hear anoda parabol: One man plant vine for en farm, fence am round, dig pit where dem go for press di fruit wey dem go take make wine and build where sekurity go stay. Den e rent di farm give farmers kon travel go far place.


“God Kingdom bi like wen one king do marriage for en son.


“God Kingdom bi like wen ten virgins karry dia lamps go meet man wey won marry wife.


“Make una turn from sin kom meet God, bikos God Kingdom don near.”


Jesus kon dey waka for Galilee dey tish inside dia sinagog. E prish about God Kingdom and dey heal pipol wey get difren-difren diziz and doz wey nor well.


Jesus ask di pipol, “Wetin God Kingdom bi like? How I won take diskribe am?


Jesus tok again sey, “Wetin I go tok sey God Kingdom bi like?


Wen una first hear about di Good News wey bring trut, una kon get love and faith for wetin God prepare for una for heaven and na dis gospel


God nor save una with human being body wey fit die, but na thru en word wey get life and dey forever.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ