Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 13:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Dis pipol nor go fit undastand; dem nor won hear anytin, dem klose dia eyes make dem nor for fit si and hear with dia ear. Dia mind don block, so dem nor go fit undastand, but if to sey dem fit turn kom meet mi, I for heal dem.’

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 13:15
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dia heart dey empty and stupid, but I dey happy for yor kommand.


Make yu dey kareful with doz wey dey look yu with bad eye, bikos dem don already dey tink bad tin about yu.


E just bi like sey dem dey chop ashes. Di foolish tins wey dem dey tink don deceive dem and dem nor fit help demsef again or tell demsef sey, ‘Nor bi lie-lie God wi dey serve so?’ ”


I don si how dem dey bihave, but I go heal dem. I go lead and help dem and I go konfort doz wey dey mourn.


Den E tell mi, “Go make dis pipol get strong heart, deaf dia ear and blind dia eyes, so dat dem nor go si, hear or undastand again. If dem bi like dat, dem go turn kom meet mi and I go heal dem.”


My God, make Yu heal mi and I go strong again; save mi and I go dey save, bikos na Yu I dey praiz.


Na wikedness full human being mind and e bad well-well. Na who go fit undastand am?


Naw, una wey nor dey faithful, make una kom back kom meet mi and I go heal una!” “Yes! Wi go kom meet Yu, bikos na Yu bi di Oga wey bi awa God.


But I go heal di town and en pipol kon make dem well again. I go give dem peace forever and dem go dey save.


So God ansa, “I go bring my pipol kom back to mi. I go love dem with all my heart and I nor go vex for dem again.


“But dem nor gri listin, instead dem klose dia ear make dem for nor hear anytin.


But for una wey dey fear my name, my sun wey dey give life go shine and heal una. Una go dey free kon dey happy like melu pikin wey dem open en kage make e for go play.


so dat, “dem go dey look, but dem nor go si, dem go dey hear, but dem nor go undastand and dem nor go fit turn from dia sin kom meet God make E forgive dem.”


den e sey, “I wish sey una know wetin go give una peace today! But naw, God don hide am from una.


Una heart nor dey undastand and una ear nor dey hear well again. Devil don klose una eye, make una nor for fit si; hear with una ears or undastand with una heart, so dat una nor go fit turn kom meet God, make E for heal una.” ’


So make una turn from sin kom meet God, make E for forgive una,


But di pipol klose dia ear bigin shaut and all of dem kon rush am.


Dem go rijet di trut and love lie-lie story.


Wi get many tins to tok about, but dem nor eazy to esplain, bikos una nor dey gri obey.


E dey rush pass di town main road. For each side for di river, di tree wey dey give life dey bear twelf fruit and e dey bear one evry mont. Di leaf for di tree na to heal evry nashon for di world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ