Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 13:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Jesus ansa dem, “God don make una know all di sekret tins about en kingdom, but dis pipol nor know.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 13:11
40 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God na friend to doz wey dey fear am and E dey tish dem en kovenant.


God don make una dey do like sey una don drink, so una go sleep go. God don blind di profets eyes and doz wey dey sey future nor go fit si anytin again.


To una, evritin wey di profet tok, bi like word wey dem rite for book kon klose am. Wen dem gi-am to pesin wey sabi read kon sey, “Read am,” e go ansa, “I nor fit, bikos dem klose am.”


One fine road go dey der and dem go koll am, “Holiness Road.” No sina go travel pass dat road and foolish pipol nor go fit deceive doz wey dey waka pass der.


Den di disciples kom meet Jesus ask am, “Why yu dey tok to dis pipol with parabol?”


Den Jesus tell am, “God go bless yu, Simon, Jonah pikin, bikos na my Papa for heaven show yu dis tin, nor bi human being.


Jesus ansa dem, “Nor bi evribody go fit asept dis word, but na only di pipol wey God give di pawa.


Jesus kon tell dem, “Na true sey una go fit drink from my cup, but e nor dey my hand to choose who go sidan for my rite and left, but na for doz wey my Papa choose.”


but nor bi mi go tok who go sidan for my left or rite side, bikos e get di pipol wey God prepare am for.”


E kon tell dem, “God don show una di kingdom sekret. But doz wey dey outside God Kingdom, na parabol e bi for dem,


Jesus ansa dem, “Una get di shance to know God Kingdom sekret, but dis oda pipol, na only parabol dem go take hear am, so dat “As dem dey look, dem nor go si and as dem hear, dem nor go undastand.


So Jesus kon sey, “Na bikos of dis I tell una sey, nobody go fit kom meet mi with en own pawa, unless my Papa let am kom.”


Anybody wey ready to do wetin God wont, di pesin go know weda wetin I dey tish na from God or na my own.


E get one woman wey dey listin to us, en name na Lydia and e kom from Tiatira. E dey fear God well-well and dey sell purpol klot. God open en heart to bilive evritin wey Paul tok.


My friends, I nor won make una dey boast about unasef. So I go tell una wetin happen to Israel pipol. Some among dem sturbon well-well and na so dem go bi until di nomba for Gentile pipol wey God wont, don komplete.


Make wi praiz God, bikos e don make una strong thru dis Good News wey I dey prish about en pikin, Jesus Christ. For many years naw, dem keep dis message for sekret,


if I dey profesai and fit undastand evry sekret and knowledge or if I get faith wey fit move mountins and I nor love oda pipol, I go bi nor-tin.


I won tell una one big sekret: Nor bi all of us go die, but all of us go shange.


So, na only who get God Spirit fit undastand spiritual blessings. Pesin wey nor get God Spirit, nor go fit undastand wetin di Spirit dey tok.


Di tin wey I dey tok about, na God sekret wisdom wey E choose for us, even before E kreate di world.


Make una dey tink about us as Christ savant wey God don show en sekret.


Wetin make una tink sey, una betta pass anoda pesin? Nor bi God give una evritin? So wetin make una dey boast wen e bi sey evritin wey una get, na God give una?


Una eye don open to undastand di grace wey God koll una kom enter and una don si how di blessing wey E promise en pipol, plenty rish.


E do like dis wen E show us di sekret plan wey E get and di good mind wey E show evribody, thru Christ.


Dis sekret wey I dey tell una so big well-well, but na di tin wey dey between Christ and di church, I dey tok about.


Make una pray for mi too sey, make God give mi betta word anytime wen I open my mout to tok and make I fit esplain di sekret wey dey di gospel.


Wetin I wont bi sey, wen una don really undastand God sekret wey dey inside Jesus Christ, make una heart dey strong with love, so dat una go get evritin wey una wont.


Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.


Dem must bi pipol wey get mind and dey prish di trut about di faith wey God don show us.


But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu.


But di pesin wey dey holy, don anoint una and all of una know sey na true.


As for una, di Holy Spirit wey Christ give una, dey stay inside una, so una nor nid anybody to tish una again. Evritin wey di Holy Spirit dey tish, na true and lie nor dey inside. Just as e don tish una, make una stay inside am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ