7 If to sey una know wetin dis tin mean: ‘Na mesi I wont, nor bi sakrifice’, una nor for kondemn pesin wey nor kommit sin.
E still vex for Job friends, bikos dem nor know how to ansa Job and evritin kon bi like sey, na God dey wrong.
bikos E dey protet pipol wey nor get, so dat E go save dem from wiked pipol wey won kondemn dem.
Dem dey plan against di pesin wey dey do wetin dey rite kon kondemn and kill innocent pipol.
God nor like pipol wey dey defend wiked pipol and kondemn doz wey dey innocent.
Nor bi animals sakrifice I wont, but na una love wey nor dey die. E betta make my pipol know mi, dan all di burnt ofrin wey dem dey give mi.
Jesus ansa dem, “Una dey make mistake, bikos una nor know God word and en pawa.
Make una go learn wetin dis word mean: ‘Na mesi I wont, nor bi sakrifice, bikos na sinnas I kom save, nor bi good pipol.’ ”
To love God with all awa heart, mind and pawa and to love awa neighbour as awasef big pass all di sakrifice and ofrins wey pesin fit give God.”
Bikos di pipol wey dey stay for Jerusalem and all di rulers nor know am, so dem kon use wetin dem dey read for Sabat Day, wey di profets tok, take kill-am.
Yu don kondemn and kill pipol wey nor do bad, bikos dem nor fit stop yu.
Naw, doz wey dem sekonsaiz, na shidren wey dem born for di desert afta dem komot from Egypt and dem neva sekonsaiz at-all.
Den Samuel sey, “Na wish one God like pass: to obey am or to offa ofrin and sakrifice? E betta to obey dan to sakrifice di best sheep gi-am.