Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 12:50 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

50 Pesin wey do wetin my Papa for heaven wont, na dat pesin bi my broda, sista and mama.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 12:50
38 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go tok about yor name for where my kountry pipol dey. I go praiz Yu for where yor pipol gada put.


My sista and wife, yu bi my sekret gardin; my fine gardin wey get en own well.


Den Jesus point to en disciples kon sey, “Na dis pipol bi my mama and brodas.


Dat same day, Jesus komot from di house go sidan for Galilee wotaside.


As e still dey tok, one brite kloud kon kover dem and one vois kon sey, “Dis na my Pikin wey I love. Make una listin to am!”


“Den di king go ansa, ‘I tell una true word, just as una do am give di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una don do am for mi.’


“Den, di king go ansa dem, ‘I tell una true word, just as una nor do am for di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una nor do am for mi.’


Den Jesus Christ tell dem, “Make una nor fear, but tell my brodas make dem go Galilee and dem go si mi for der.”


Bikos anybody wey do wetin God wont, na-im bi my broda, sista and mama.”


Jesus ansa, “My mama and brodas na pipol wey dey hear and obey God word.”


Una go bi my friend if una do wetin I tok.


Jesus ansa am, “Make yu neva tosh mi, bikos I neva go meet my Papa for heaven. Go meet my brodas, tell dem sey, ‘I dey go heaven go meet my Papa, wey bi yor Papa too; my God, wey bi yor God too.’ ”


Jesus ansa, “God wont sey make una bilive di pesin wey E send.”


Wetin my Papa wont bi sey, anybody wey bilive en pikin, go get life wey nor dey end and I go wake am up for di last day.”


God don forgive us for di time wen wi nor know wetin wi dey do, but naw, E dey kommand pipol for evriwhere sey make dem turn from sin kom meet am,


but I first go Damaskus, go tell di pipol wey dey der and den, I kon go meet di pipol wey dey for Jerusalem and Judea. Afta, I go meet Gentile pipol sey, make dem turn from sin kom meet God and make dem do tins wey go show sey, dem don really turn from sin kom meet God.


God know doz wey E don choose, so E don make dem bi like en Pikin, so dat en pikin go bi di first-born.


abi wi nor get rite to marry biliver for Christ?


I dey jealous for una with God jealousy, bikos I promise sey na one man una go marry. Like woman wey nor no man, na so I won give una to Christ.


For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.


Weda pesin sekonsaiz or not, e nor mean anytin, di only tin wey matter bi sey, una don turn to new pesin.


For heaven, e nor get anytin like Greek or Jew pesin; pesin wey dem sekonsaiz or not; bush pesin; pipol wey dey chop human being; slave or free pesin, but na Christ bi all and e dey inside all of us.


Make yu trit wimen wey old pass yu like sey dem bi yor mama and wimen wey yu senior, make yu trit dem with good mind like sey dem bi yor sistas.


Wen God don make Christ pafet finish, e kon save evribody wey obey am.


bikos e don do wetin God wont and nor bi wetin pipol wont.


And dis world don dey fade with di tins wey pipol wont, but di pesin wey dey do wetin God wont, go dey forever.


God don bless doz wey wosh dia klot klean, so dem go get authority to chop from di tree wey dey give life and dem go fit pass di gate enter di town.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ