4 how dem enter God house kon chop di holy bread wey ordinary pipol nor suppose chop, bikos na only priests suppose to chop am?
Yu must always keep di Holy Bread wey yu go give mi on-top di tabol.
Moses tell Aaron and en sons sey, “Make una boil di meat for di tent gate kon chop am for der with di bread wey dey di ordinashon ofrin basket, just as God kommand.
Jesus ansa, “Una neva read wetin David do wen en and en pipol dey hongry,
Or una neva read for Moses Law sey, priests dey work for Sabat Day, but nobody dey sey dem kommit sin?
How en and en men enter God house wen Abiatar bi High Priest kon chop di holy bread wey only priests suppose chop?”
E enter God house kon take di bread wey holy wey only priests suppose chop and en and en men chop am.”
Di building get two rooms. Di first one where lantan-stand dey, “Na di Holy Place.” One tabol and di bread wey dem offa give God, dey der too.
Di priest ansa David, “I nor get ordinary bread, na only di holy bread dey and di sojas go fit chop am if dem nor sleep with woman.”
So di priest give David di holy bread, bikos no oda bread dey der. Dem take am from God present, so dat dem go put hot ones for der.