37 Na di word wey yu dey tok, naim go fit free or kondemn yu for God present.”
Doz wey dey kontrol dia tongue go get long life, bikos anyhow word dey distroy tins.
Wetin yu tok fit save or distroy yor life. So yu must asept di result of wetin yu tok.
I tell una true word, for judgement day, pipol go ansa God for all di yeye word wey dem tok.
Some of dem wey bi law tisha and Farisee pipol kon tell Jesus, “Tisha, wi wont make yu show us sign.”