33 “Good tree dey bear good fruit and bad tree dey bear bad fruit. Na di fruit wey tree bear, naim pipol take dey know di kind tree wey e bi.
Make una stop all di bad and wiked tins wey una dey do, so dat una go get new mind and heart. Israel pipol, why una like to die?
Make una hate bad tins kon love to do good, den dey judge well for kourt. May bi God go sorry for di pipol wey still remain for dis land.
Una Farisee pipol wey blind! Make una first wosh inside di cup, den di outside go klean too!
Even naw sef, di axe don ready to kut di tree wey nor dey bear betta fruit, dem go kut am down kon trow am inside fire.”
My brodas and sistas, fig tree go fit bear olive, abi vine fit bear fig? So too, wota wey dey kom out from groun and e taste like salt, nor go fit taste like fresh wota at-all.
Draw near God and E go draw near yu. Una wey bi sina, make una wosh una hand and una wey get doubol mind, make una heart dey klean.