Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 12:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 So if Satan dey drive Satan komot, e don divide ensef bi dat, den how en kingdom go fit stand?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 12:26
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

‘Wen pesin hear God word and e nor undastand am, di devil go kom tif di word wey dem plant for en heart, dis na di seed wey fall for road.


Jesus ansa, “Komot here, devil! Bikos God word sey, ‘Na only God wi suppose to serve and woship.’ ”


But di Farisee pipol sey, “Na devil pawa Jesus dey use take drive demon komot from pipol body.”


Di time to judge di pipol for dis world don rish and God go drive Satan, wey dey kontrol dis world komot.


I nor go tok too mush naw, bikos di devil wey dey rule dis world, dey kom and e nor get pawa for my body.


And dem dey wrong about judgement, bikos God don kondemn di pesin wey dey rule dis world.


bikos doz wey nor bilive, di gods for dis time don blind dia mind, so dem nor go si lite wey dey dis gospel wey get glory and dis gospel na Christ wey bi God image.


E save us from darkness pawa and put us for di kingdom wey E give di pikin wey E love.


Wi know sey wi bi God shidren and dis world wey wi dey so, na wiked pipol dey rule am.


Dis dragon na di old snake wey bi di devil or Satan, wey dey deceive di world. Dem trow am kom down from heaven with en angels.


Den di fift angel pour wetin dey en basin put for di beast throne, at wons, darkness kover di beast kingdom and di pain kon dey make dem bite dia tongue.


Na dia king bi di angel wey kom from di pit and en name for Hibru, na Abaddon and for Greek, na Apollon (pesin wey dey distroy).


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ