Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 11:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 Yes! Papa, na so yu wont make e bi.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 11:26
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Why yu dey akuiz God sey E nor dey ever ansa yor komplain?


I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am.


For dat time, di Holy Spirit kon make Jesus dey happy, so e kon sey, “I praiz yu, Papa wey bi Oga God for heaven and eart, bikos yu don hide dis tins from pipol wey get sense and wise, but yu show dem to yor shidren. Yes, Papa, na so yu wont make e bi.


“Papa, if yu like to do am, make yu let dis sofa cup pass mi. But make e bi as yu wont, nor bi as I wont am.”


(Den Jesus kon sey, “Papa, make yu forgive dem, bikos dem nor know wetin dem dey do.”) So, di sojas kon gambol to know who go take Jesus klot.


So, dem kon roll di stone komot from di grave mout. Den Jesus look heaven kon sey, “Papa, I tank Yu sey Yu dey always hear mi and dey do di tins wey I ask from Yu.


“My heart heavy well-well. Wetin I go tok? ‘Papa, make yu save mi from dis tin wey won happen’? No! Na dis tin make mi kom dis world.


Papa, make yu honor yor name.” Den one vois tok from heaven sey, “I don honor am before and I go honor am again.”


So, God dey sorry for who E won sorry for and dey ponish who E won ponish.


All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,


E do like dis wen E show us di sekret plan wey E get and di good mind wey E show evribody, thru Christ.


Dis happen akordin to en plan wey go stand forever and E make am happen thru awa Oga God Jesus Christ


Bikos God save and koll us to live holy life. E do like dis, nor bi sey wi deserve am bikos of wetin wi do, but na so E plan am even before di world start, so dat wey go know en grace thru Jesus Christ.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ