Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 10:42 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

42 And anybody wey give kold wota to di pesin wey small pass among my disciples, I tell una true word, e nor go ever luz en reward.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 10:42
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As di woman dey go bring am, e still tell am, “Make yu still bring bread kom for mi too.”


so make wi make one small room for up kon put bed, tabol, chair and lantan for der, so dat wen ever e kom, e go stay here with us.”


Wen yu give sometin to poor pipol, e bi like sey God dey borrow from yu and God go pay yu evritin wey E borrow.


na so wisdom dey good for di soul. Make yu get wisdom and yor future go dey sikure.


Put yor money for betta business and e nor go tey before yu go bigin gain am.


God wey dey mighty sey, “Swod! Make yu go attack and kill di shepad wey dey work for mi, den all di sheep go skata. I go attack my pipol


“Make sure sey una nor porshu any of dis small shidren komot. I tell una di trut, dia angels dey my Papa front for heaven evritime.


Na like dis too yor Papa for heaven nor wont make any of en shidren lost.”


“Den di king go ansa, ‘I tell una true word, just as una do am give di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una don do am for mi.’


E betta make dem tie big stone for di pesin neck, trow am for river, dan sey e make any of dis small-small wons kommit sin.


But make una love una enemies kon do good and make una nor espect anytin back wen una borrow anybody sometin. Na dis go make God pay una back and una go bi en shidren, bikos God ensef dey do good for wiked pipol and doz wey nor dey sey tank yu.


Bikos if e really dey una mind to do am, anytin wey una give akordin to wetin una get, God go asept am, but nor bi wetin una nor get.


God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ