Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 10:40 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

40 “Pesin wey welkom yu, welkom mi too and anybody wey welkom mi, welkom di Pesin wey send mi.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 10:40
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen Jezebel dey kill God profets, Obadaya hide hundred profets for two kave; fifty-fifty for each kave and e dey bring food and wota kon give dem.


But mi, wey bi God go protet yu from di pipol wey yu dey fear.


“Anybody wey welkom one pikin like dis one for my name, welkom mi.


“Den di king go ansa, ‘I tell una true word, just as una do am give di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una don do am for mi.’


“Den, di king go ansa dem, ‘I tell una true word, just as una nor do am for di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una nor do am for mi.’


“Anybody wey welkom one of dis small pikin bikos of mi, na mi e welkom and anybody wey welkom mi, nor bi mi alone e welkom, but na my Papa wey send mi.”


Jesus tell en disciples, “Anybody wey listin to una, don listin to mi and anybody wey rijet una, don rijet mi and God wey send mi.”


kon tell dem, “Anybody wey welkom dis small pikin bikos of mi, don welkom mi and anybody wey welkom mi, don welkom God wey send mi, bikos di pesin wey small pass among una, na-im big pass for God Kingdom.”


I dey tell una true word, anybody wey receive di pesin wey I send, don receive mi and anybody wey receive mi, don receive God wey send mi kom.”


Den Jesus tell dem again, “Make peace dey with una. As my Papa send mi, na so I send una too.”


so dat evribody go bow down for di pikin as dem dey bow down for di Papa. If anybody nor bow show respet for di pikin, e nor go get di mind to respet di Papa wey send di pikin kom.


Wi dey ripresent Christ, so dat God go tok to una, thru us. Wi dey beg una bikos of Christ sey, “Make una shange kon bi God friend!”


even doh my sickness na problem to una, una nor laf or drive mi. Instead, una welkom mi like God angel; like sey na mi bi Jesus Christ!


So, anybody wey rijet wetin wi tok; nor bi human being authority e rijet, but na God wey give una en Holy Spirit.


Pesin wey nor dey follow wetin Christ tish, but dey find oda yeye tishas, nor know God. But pesin wey dey obey dis tishing, get both di Papa and en Pikin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ