Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 10:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Simon wey bi Zealot (pesin wey dey fight for en kountry) and Judas Iskariot wey sell Jesus Christ.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 10:4
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Judas Iskariot, wey dey among di twelf disciples go meet di priest oga dem,


kon tell dem, “Wetin una go give mi, if I sell Jesus Christ give una?” So dem kon kount thirty silva koins gi-am.


“Make una know sey na two days remain before di Passova go start and dem go give Man Pikin to pipol wey go nail am for cross.”


As Jesus still dey tok, Judas wey bi one of di disciples, kon kom. Plenty pipol wey di priest oga and eldas send, karry gun and big stik dey follow Judas for back.


Wen Judas wey sell Jesus si sey dem kondemn am, en mind kon dey judge am for wetin e do, so e riton di thirty silva koins give di priest oga dem and eldas,


Den Judas Iskariot, wey dey among Jesus disciples, kon go meet di priest oga dem sey e won sell Jesus give dem.


As Jesus still dey tok, Judas, one of di twelf disciples kon kom with plenty pipol wey di priest oga dem, di law tishas and di eldas send and all of dem karry swod and big-big stik.


So, Satan enter inside Judas Iskariot, one of Jesus twelf disciples.


As Jesus still dey tok, at wons, some pipol waka kom and na Judas lead dem. E waka go meet Jesus kon kiss am for face.


Before dem start to chop evening food, devil don already enter Judas Iskariot mind, wey bi Simon pikin sey, make e sell Jesus give en enemy.


But some of una nor bilive.” (From biginnin, Jesus don know di pipol wey nor go bilive and di pesin wey go sell am give en enemy.)


(E tok dis one about Judas, wey bi Simon Iskariot pikin, bikos na dis Judas, wey bi one among en twelf disciples, naim go sell am give en enemy.)


Wen dem enter Jerusalem, dem kon go di room for upstair where dem dey stay. Pita and John; James and Andru; Filip and Tomas; Bartolomew and Matiu; James wey bi Afaeus pikin, Simon wey dem dey koll Zealot and Judas wey bi James pikin, na all of dem gada for der.


so dat e go take Apostle Judas, wey kill ensef, place.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ