38 Anybody wey nor karry en cross follow mi, nor go fit bi my disciple.
Den Jesus tell en disciples, “If anybody won follow mi, e must deny ensef, karry en cross and follow mi.
As dem dey go outside, dem si one man from Sirene wey en name na Simon and dem kon force am make e karry Jesus Christ cross.
As Jesus look am, e kon feel for am, den e tell am, “E get one tin wey yu neva do. Go sell all wetin yu get, give poor pipol di money and yu go get plenty propaty for heaven. Den make yu kom follow mi.”
Den Jesus koll di pipol with en disciples kon tell dem, “If anybody one follow mi, e must deny ensef, karry en cross, den kon follow mi.
Anybody wey nor gri karry en cross follow mi, nor fit bi my disciple.
As Jesus karry en cross dey go, e kon rish di place wey dem dey koll “Di Skull” (na Golgota dem dey koll di place for Aramaik language.)