So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.
God sey, “Israel pipol, as una small and dey weak rish, make una nor fear, bikos I go help una. Mi wey bi Israel God wey dey holy, na mi bi di only Pesin wey go save una.
But yu, my pikin, even doh dem beat and do yu anyhow like sey yu dey stay with skorpions, make yu nor fear dem or anytin wey dem tok. Nor fear anytin wey dem tok or di way wey dem go dey look yu, bikos all of dem sturbon well-well.
but una go get pawa wen di Holy Spirit don enter una life and una go tell pipol about mi for Jerusalem, for evriwhere for Judea and Samaria go rish all di far place wey dey dis world.”
Di oga dem sopraiz wen dem si how Pita and John take tok even doh dem nor go skool. So dem kon know sey dis na di pipol wey don follow Jesus Christ waka.
So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.