13 And if di pipol inside di house welkom una, make una peace stay with dem, but if dem nor welkom una, una peace go kom back to una.
Wen dem dey sick, I dey sorry for dem. I dey ponish mysef as I dey fast for dem. If I dey lie, make God nor ansa my prayers!
Any house wey una enter, make una greet di pipol wey dey inside.
If di pipol nor welkom or listin to una message, make una shake dia san komot from una leg as una dey leave dat house or town.
If anybody wey wont peace dey der, una peace go stay with am, but if e nor dey, una peace go kom back to una.
To doz wey don lost, e bi like sometin wey dey kill; but for doz wey Christ don save, e bi like smell wey dey give life. So, who go fit handle all dis tins?