12 Any house wey una enter, make una greet di pipol wey dey inside.
My Jerusalem, make peace follow yu and yor palis go dey prosper forever.
Bikos of my family and friends, I go sey, “Make peace follow yu.”
Weda dem listin to yu or not, dem go know sey one profet don kom meet dem.
“Wen una enter any town or village, make una look for pesin wey ready to receive una for en house, make una stay with am until una komot from dat town.
And if di pipol inside di house welkom una, make una peace stay with dem, but if dem nor welkom una, una peace go kom back to una.
Una know di message wey E send to Israel pipol, wen E tok about di Good News wey dey give peace, thru Jesus Christ, di real Oga God.
Wi dey ripresent Christ, so dat God go tok to una, thru us. Wi dey beg una bikos of Christ sey, “Make una shange kon bi God friend!”
I dey hope sey I go soon si yu and wi go tok face-to-face.
Den una go tell am, ‘Make peace dey with yu and yor house! Make peace dey with evritin wey bi yor own!