Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 10:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Jesus koll en twelf disciples kon give dem pawa to drive demons and heal diziz and pipol wey nor well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 10:1
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jesus ansa am, “I tell yu true word, for dat time wen evritin go dey new, Man Pikin go sidan for en throne wey get glory and una wey dey follow mi, go sidan for twelf thrones, dey judge di twelf tribes wey dey Israel.


Wen evening rish, Jesus sidan for di tabol with en twelf disciples.


As Jesus still dey tok, Judas wey bi one of di disciples, kon kom. Plenty pipol wey di priest oga and eldas send, karry gun and big stik dey follow Judas for back.


Jesus kon dey waka for Galilee dey tish inside dia sinagog. E prish about God Kingdom and dey heal pipol wey get difren-difren diziz and doz wey nor well.


Nor allow us enter temptashon, but make yu save us from bad tins.’


Jesus waka go all di town and village, dey prish di Good News about God Kingdom for dia sinagog and dey heal difren diziz and pipol wey nor well.


So, make una pray make di Oga God wey get di farm, send pipol wey go work for en farm, kom.


Make una listin, I don give una pawa to waka on-top snake and skorpion and to ovakom all di enemy pawa, so nor-tin go fit wound una.


bikos I go give una di word wey una go tok and wisdom wey una enemy nor go fit oppoz.


I dey send wetin my Papa promise kom meet una. So make una stay for dis town until pawa go kom from heaven kon kover una.”


Wen day break, Jesus koll en disciples kon choose twelf among dem wey e koll apostles:


Just as yu don give mi pawa ova all di pipol for di world, na so too I go give life wey nor dey end to evribody wey yu give mi.


John ansa dem, “Nobody go fit get anytin unless God wey dey heaven, gi-am.


God love en pikin well-well and E gi-am pawa to kontrol evritin.


Jesus ansa, “Nor bi twelf of una I choose? But one pesin among una na devil pikin.”


but una go get pawa wen di Holy Spirit don enter una life and una go tell pipol about mi for Jerusalem, for evriwhere for Judea and Samaria go rish all di far place wey dey dis world.”


But di evil spirit ansa dem, “Yes! I know who Jesus Christ bi, I still know Paul too, but who una bi?”


Den one big sign kon appear for heaven: I si one woman wey take sun tie en body like klot, di moon dey under en leg and one crown with twelf stars, dey for en head.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ