5 Salmon born Boaz (wey Rahab bi en mama), na Boaz bi Obed papa (wey Rut bi en mama), Obed kon born Jesse,
Ram na Amminadab papa, Amminadab born Nashon, Nashon kon born Salmon,
Jesse born David wey bi Israel pipol king. David born Solomon (wey Uraya wife bi en mama),
Jesse wey Obed born, naim bi David papa. Obed papa na Boaz, wey bi Salmon pikin, wey bi Nashon pikin.
Na faith make Rahab, wey bi ashawo, eskape wen God distroy pipol wey nor obey am, bikos e welkom di pipol wey kom spy.
Nor bi so e bi for Rahab, wey bi ashawo, wen e welkom di messenjas kon show dem anoda road wey dem go pass run?
So na like dis Naomi take kom back from Moab with Rut, en pikin, Mahlon wife. Dem rish Betlehem wen grain harvest just dey start.
So di shidren marry wimen from Moab and dia name na Orpah and Rut. Dem kon stay for Moab for anoda ten years.
and Salmon born Boaz wey bi Oded papa.