Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 1:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Josef wey won marry am, na pesin wey dey fear God well-well and bikos e nor won disgrace am, e kon tink for en mind sey e nor go marry Mary again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 1:19
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Afta three monts, dem kon tell Judah sey, “Yor pikin wife Tamar don turn to ashawo and e don get belle.” Judah kon sey, “Make una go bring Tamar kom make dem burn am!”


Dis na Noah story. Noah na pesin wey dey fear God; e nor get fault for body among evry oda human being. E dey waka with di Oga God.


“ ‘If man sleep with woman slave wey anoda man suppose marry and dem neva free or pay money for en head, den dem must pay evritin komplete. Dem nor go kill-am, bikos di woman na slave.


If anybody sleep with en neighbour wife, dem must kill both di man and di woman.


Dem ansa, “Moses sey make man rite leta to divorce en wife.”


Herod dey fear John well-well, so e dey protet am, bikos e know sey John na holy man wey dey do wetin God like. Anytime Herod hear John dey prish, en mind go dey worry am, but e still dey like to listin to am.


One man dey Jerusalem wey en name bi Simeon and di Holy Spirit dey inside am. Di man dey fear God and dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God go free Israel.


Dem ansa, “Kornelius, di soja offisa, wey dey do good tins and dey woship God well-well, wey all Jew pipol dey respet, na-im send us kom. One angel kommand am sey make e invite yu kom prish gi-am.”


Wen day break, dem nor know where dem dey, but dem si one small land wey near di sea and dem tok for dia mind sey, if e dey possibol dem go use di ship take enter di land.


Na with dis mind I bi won take kom meet una before, so dat wi go bless una again.


But if wetin di man tok na true and e show sey di woman nor bi virgin,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ