Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 1:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Josaya born Jekonaya and en brodas for di time wey dem karry Israel pipol go bi slave for Babilon.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 1:11
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jehoahaz na twenty-three years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for three monts. En mama name na Hamutal wey bi Jeremaya from Libnah, pikin.


King Nebukadnezzar karry evribody komot from Jerusalem, plus di ofisas and sojas (all di pipol, na 10,000). Plus all di men wey get skill and doz wey dey work with iron. E nor leave anybody esept di poor pipol wey dey di land.


Nebuzaradan karry all di remainin pipol wey dey di town and doz for wildaness wey run from King Nebukadnezzar, plus evry oda pesin go Babilon.


Wen di year just start, King Nebukadnezzar kon give orda sey make dem bring am with di betta tins wey dey for God Temple kom Babilon. E make Zedekaya wey bi en family memba, king for en place for Jerusalem.


Di king karry all di pipol wey e nor kill go Babilon as slave and dem serve en and en shidren till Persia kingdom start to reign.


Dis na di message wey God give Isaya wey bi Amos pikin about Babilon.


wen Nebukadnezzar, Babilon king kon karry Judah King, Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin and en ofisas for Judah and Jerusalem, go Babilon as slave.


Den Nebuzaradan, wey dey kommand di sojas kon karry di pipol wey remain for di town and di ones wey nor strong, go Babilon as prisonas.


God allow King Nebukadnezzar katch King Jehoiakim and e karry some of di tins wey dey God temple too. E karry Judah pipol as prisonas go Babilon and di tins wey e karry from Jerusalem, e put dem for en own juju temple.


Afta dem karry Israel pipol go Babilon, Jekonaya kon born Shealtiel, Shealtiel kon bi Zerubabel papa,


So, from Abraham go rish David time, na fourteen generashon dey and from David time go rish wen dem karry Israel pipol go Babilon, na fourteen too and from dat time go rish wen dem born Jesus Christ, na fourteen generashon e bi.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ