Just as God kommand, di profet curse di altar kon sey, “Dis altar! Dis altar! Na wetin God tok bi dis. Dem go born one pikin wey en name go bi Josaya for David family and e go kut and burn di pagan priest wey dey serve and do sakrifice for dis altar.”
Hezekaya die and dem beri am for David shidren-shidren grave. Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem beri am with honor. En pikin Manasseh kon take-ova as king.