Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mark 9:47 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

47 If yor eye go make yu sin, make yu pul am komot! E betta make yu enter God Kingdom with one eye, dan to get two eye kon enter hell-fire wey nor dey ever kwensh,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mark 9:47
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen di woman si sey di fruit wey di tree dey produce fine well-well and e good to chop; and e go make pesin get sense well-well, e kon take some of di fruit chop. Di woman still give some to en husband wey dey with am and e kon chop too.


“I don swear with my eye sey I nor go ever look wimen kon sey I won sleep with dem.


Make Yu help mi take my eyes komot from tins wey nor mean anytin and give mi life thru yor word.


If yor eye dey make yu sin, make yu pul am trowey. E betta make yu enter God Kingdom with one eye, down sey God trow yu enter hell-fire with two eyes.”


But I tell una, anybody wey vex for en broda, God go judge am too. Anybody wey curse en broda, go face di kansol and anybody wey koll pesin, ‘Mumu’, go-go hell-fire.


If yor hand go make yu sin, make yu kut am komot! E betta make yu enter inside God Kingdom with one hand, dan to get two hand kon enter hell-fire wey nor go ever kwensh,


di place wey get worm wey nor dey die and di fire nor dey kwensh.


“If anybody kom meet mi and e nor love mi pass en papa, mama, wife, pikin, brodas and sistas, even en ownsef, e nor go fit bi my disciple.


Jesus tell am, “Make I tell yu true word, unless dem born pesin di sekond time, e nor go fit si God kingdom.”


Jesus ansa am, “I tell yu di trut, unless God born pesin with wota and en Spirit, di pesin nor go fit enter God kingdom.


Naw, na wetin don happen to una happiness? I know sey, if to sey e dey possibol, una for pul una eye give mi!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ