Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mark 9:44 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

44 di place wey get worm wey nor dey die and di fire nor dey kwensh.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mark 9:44
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Zion pipol wey dey sin, dey fear! Pipol wey nor dey fear God, dey shake. Dem sey, “E get any one of us wey fit survive dat kind fire?”


All doz wey bin fight mi, dem go si dia dead body for road. Di worms wey chop dem nor go ever die and dem nor go ever kwensh di fire wey go burn dem. Dia dead body nor go dey good for human being to si.”


“Di king go tell di pipol wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare for devil and en wiked angels.


“So wiked pipol go enter ponishment wey nor go end, but raitious pipol go get life wey nor go end too.”


Di fan wey e go take blow kanda komot from korn, dey en hand and e go gada and keep en korn inside store kon burn di dirty for faya wey nor dey kwensh.”


If yor hand go make yu sin, make yu kut am komot! E betta make yu enter inside God Kingdom with one hand, dan to get two hand kon enter hell-fire wey nor go ever kwensh,


If yor leg go make yu sin, make yu kut am komot. E betta make yu enter God Kingdom with one leg, dan to get two leg kon enter hell-fire wey nor dey ever kwensh,


“di place wey get worm wey nor dey die and di fire nor dey kwensh.


God go distroy dem and dia ponishment nor go ever end. Wen Christ go kom receive glory from di pipol wey e choose,


e go drink from God vexnashon wey dey inside en ponishment cup. God go ponish am with fire and sulfur for en holy angels and Lamb front.


Den, dem go trow di devil wey deceive pipol inside God fire. Den di beast and en fake profets go sofa both day and nite forever and ever.


Anybody wey dem nor si en name inside di Life Book, dem go trowey am inside di big fire.


But for pipol wey fear nor dey let dem do wetin good; doz wey nor bilive mi, doz wey nor dey obey mi; doz wey kill odas; pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey do majik; pipol wey dey serve juju and evribody wey dey tok lie, na inside di fire and sulfur dem go-go. And na dat bi di sekond deat.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ