But Jesus turn look en disciples kon shaut for Pita, “Satan! Make yu go my back, bikos yu nor put yor mind for wetin God wont. Na wetin human being wont, na der yor mind dey.”
But dem nor undastand dis word, bikos God hide am from dem make dem for nor know wetin di word mean. Di disciples demsef dey fear to ask Jesus about di matter.
Jesus si sey dem won ask am about wetin e tell dem, naim e ask dem, “Una dey ask each oda wetin I mean wen I sey, ‘Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi?’
Wen Jesus dey tok to di woman, en disciples kon kom back. Dem sopraiz sey e dey tok with one woman, but dem nor fit ask am, “Wetin e wont?” or “Why e dey tok to di woman?”