Anytime di spirit seize am, e go trow am down and e go dey bring foam from en mout, dey grind en tit and en body go kon strait. I tell yor disciples make dem drive di demon komot, but dem nor fit.”
So, dem take di boy go meet am. Wen di spirit si Jesus, e kwik-kwik trow di boy for groun kon make am dey shake. Di boy fall for groun, dey roll and foam dey komot from en mout.
Wen Jesus si sey pipol dey gada, e kon tell di evil spirit, “Yu deaf and dumb spirit, I kommand make yu kom out from di boy and nor enter en body again.”