Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mark 9:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Wen Jesus si sey pipol dey gada, e kon tell di evil spirit, “Yu deaf and dumb spirit, I kommand make yu kom out from di boy and nor enter en body again.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mark 9:25
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Oga God tell Satan, “Satan! Mi wey bi God rijet all wetin yu tok. Yes! God wey love Jerusalem go kondemn yu. Dis man nor bi like stik wey dem take komot from fire?”


So dem kon bring one blind man wey get demon and nor fit tok, kom meet Jesus. Jesus heal am and di man kon dey si and tok.


Den Jesus kommand di demon komot from di boy body and at wons, di boy kon well.


Wen di pipol si Jesus, dem sopraiz kon run kwik-kwik go greet am.


Kwik-kwik di boy papa kon shaut, “I bilive o-o! Help mi make I bilive more-more!”


Di demon shaut, shake di boy well-well kon komot from en body. Di boy sleep for groun sotey many pipol kon dey sey, “E don die!”


One day, Jesus kon drive demon wey dey make pesin nor fit tok komot for one man body. Wen di demon don komot, di man bigin tok and di pipol sopraiz well-well.


But Jesus tell am: “Make yu shut up! Yu demon, komot for en body.” Di demon trow di man for groun for dia front kon komot for en body, but di man nor wound.


Demons dey shaut dey komot from many pipol body, dey sey, “Yu bi God Pikin!” But Jesus warn dem make dem nor tok, bikos dem know sey, naim bi di Mezaya.


E shaut, bikos Jesus don first kommand di evil spirit make e komot for en body (bikos di evil spirit don disturb di man well-well and dem dey shain and guide am. But e dey break di shain and di demon go drive am go inside wildaness.)


As di boy dey kom, di demon trow am for groun, e start to dey shake and foam kon dey komot from en mout. Den Jesus kommand di demon make e komot and e heal di boy, kon gi-am to en papa.


E kontinue to dey shaut like dis for many days. So di tin vex Paul well-well, naim e turn face di girl kon tell di spirit, “I kommand yu with Jesus Christ name, komot for dis girl body!” At wons, di spirit komot from di girl body.


But wen Mikael, di big angel dey kworel with devil bikos of Moses body, e nor curse am, but instead, e sey, “Na God go judge yu!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ