22 Di spirit dey always trow am inside fire or wota make e for die. But if yu go fit do anytin, make yu sorry for am and help us.”
At wons, Jesus stresh en hand katch am kon tell am, “Yor faith too small. Why yu dey doubt mi?”
beg am sey, “Oga God, make yu sorry for my son, bikos e nor well and many times, di sickness dey sofa and trow am inside fire and wota.
Jesus sorry for dem, so e tosh dia eye. At wons, dem bigin si and dem kon follow Jesus.
One leper kon meet am, knee down for en front, kon sey, “Oga God, if yu wont, yu go fit heal mi, so dat my body go well.”
Wen Jesus don enter di house, di two blind men kom meet am. Den e ask dem, “Una bilive sey I fit make una si?” Dem ansa, “Yes Oga God, yu fit.”
But Jesus nor gri make di man follow dem. Instead e tell am, “Go yor house go meet yor pipol and make yu tell dem wetin God don do for yu, bikos God don sorry for yu.”
Jesus ask di boy papa, “Since wen dis tin don dey do am?” Di papa ansa, “Na since e bi small pikin.
Den Jesus ask am, “Yu mean, ‘If I fit?’ Evritin dey possibol for di pesin wey bilive.”
Wen Jesus si di woman, e sorry for am kon tell am, “Make yu nor kry again.”