29 Jesus ask dem again, “But who una sey I bi?” Pita kon ansa, “Yu bi di Mezaya.”
E kon tell dem, “God don show una di kingdom sekret. But doz wey dey outside God Kingdom, na parabol e bi for dem,
Den Jesus ask dem, “But who una tok sey I bi?” Pita kon ansa, “Yu bi di Mezaya wey God send.”
Marta kon ansa, “Yes! Oga God, I bilive sey yu bi Christ, God Pikin, wey kom dis world.”
Den dem kon tell di woman, “Nor bi wetin yu tell us make us bilive, but bikos wi don take awa own ear hear and wi don know sey, dis pesin true-true, na-im go save all di pipol wey dey dis world.”
Den Simon Pita ansa am, “Oga God, na who wi go kon go meet? Na yu get di word wey dey give pipol di life wey nor dey end.
Wi don bilive and know sey, ‘Na yu bi di Holy One wey God send kom meet us.’ ”
As dem dey go, dem kon rish where wota dey, naim di man sey, “Si, wota dey here! Wetin go make mi nor baptize naw?”
At wons, e kon start to dey prish for di sinagog sey Jesus Christ na God Pikin.
So, una wey bilive don know en value, but for di pipol and builders wey nor bilive, dat Stone don kon bi di main stone.
If anybody sey Jesus na God Pikin, dat show sey, God dey inside am and e dey inside God too.
Anybody wey bilive sey na Jesus bi Christ, don bi God pikin and anybody wey love di Papa, love di pikin wey E born.