28 Dem ansa, “Some sey yu bi John di Baptist, odas sey, yu bi Elijah and some still sey, yu bi one for di profets.”
Make una si, I go send Profet Elijah kom meet una, before God Judgement Day go kom.
so e kon tell en savants, “Dis na John di Baptist wey wake-up from deat! Naim make am get pawa to do all dis mirakle.”
Dem ansa, “Some pipol sey yu bi John di Baptist, odas sey yu bi Elijah and some dey sey na Jeremaya or one oda profet naim yu bi.”
Den dem ask am, “So, na who yu bi? Abi yu bi Elijah?” E kon sey, “No, I nor bi Elijah.” Dem ask am again, “Yu bi di profet?” E ansa, “No o-o!”