26 E kon tell di man make e dey go en house, but e warn am sey, “Make yu nor go inside di village again.”
But e warn dem sey, make dem nor tell anybody who e bi.
Den, Jesus tell am, “Nor tell anybody, but go meet di priest, make e look yu. Afta, go give di ofrin wey Moses kommand to show sey yu don well.”
At wons, dia eyes kon open and dem kon bigin si. Jesus kon warn dem sey, “Make una nor tell anybody wetin happen so.”
But Jesus warm dem well-well sey, make dem nor let anybody know wetin happen so, den e kon tell dem make dem give di pikin food chop.
Jesus kon sey make dem nor tell anybody wetin happen. But dem kon dey tok am for evriwhere.
E hold di man for hand kon take am go outside di village. Jesus spit for di man eye kon tosh am, den ask am, “Yu dey si anytin?”
Jesus tosh di man eye again. Di man eye kon open and e kon dey si well-well.