Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mark 8:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Una get eye, but una nor fit take am si? Una get ear, but una nor fit take am hear? Una nor dey remember anytin at-all?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mark 8:18
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make dia eyes blind and make dem dey shake with fear!


Dis pipol nor get sense and dem nor know wetin dem dey do, bikos dem don klose dia eyes and mind against di trut.


Make una listin, ‘Una bi fool and una nor get sense. Una get eye, but una nor dey si; una get ear, but una nor dey hear.’ ”


“Man pikin, na where sturbon pipol der yu dey stay. Dem get eye, but dem nor dey si; dem get ear, but dem nor der hear, bikos dem sturbon well-well.


so dat, “dem go dey look, but dem nor go si, dem go dey hear, but dem nor go undastand and dem nor go fit turn from dia sin kom meet God make E forgive dem.”


“God don blind dia eye and make dia heart strong like stone, so dat dem nor go si with dia eye and undastand with dia heart, so dem nor go fit kom meet mi, make I for heal dem.”


just as God word sey: “God make dem foolish sotey dia eye nor dey si and dia ear nor dey hear till today.”


But till today, God neva make una undastand all dis tins or give una eyes wey fit si or ear wey dey hear!


Una remember sey wen I dey with una before, I tell una all dis tins.


I go dey remind una dis tins evritime, even doh I know sey una know dem and naw, una leg don strong for di trut wey una bilive.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ