Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mark 8:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon tell dem, “Why una dey tok about bread wey una nor take? Una nor dey si or undastand? Na so una foolish rish?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mark 8:17
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Why Yu make us komot from yor plans and ways? Why Yu make us sturbon like dat, sotey wi turn from Yu? Make Yu kom back, bikos of doz wey dey serve Yu and bikos of di pipol wey bi yor own.


Wen Jesus hear sey dem dey plan to kill-am, e kon komot from der. Many pipol follow am and e kon heal all of dem wey nor well.


Una nor know sey anytin wey pesin chop enter belle, e go shit am kom out?


So dem kon dey tok among demsef sey, “Na bikos wi nor bring bread, naim make am dey tok like dis.”


Den Jesus appear to di eleven disciples wen dem dey chop. E shaut give dem since dem nor bilive, bikos of dia strong heart.


At wons, Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, so e kon ask dem, “Why una dey tink like dis?


So Jesus vex kon look dem round, bikos dia heart strong well-well, den e tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon well again.


bikos dem konfuse and dem nor undastand how Jesus take feed 5,000 pipol.


So, dem kon dey tok to each oda about di bread wey dem nor take follow body.


So Jesus tell dem, “Una nor get sense and una nor dey kwik bilive wetin all di profets tok.


Naw wi know sey yu know evritin and yu nor nid anybody to ask yu any kweshon. Bikos of dis, wi bilive sey na God send yu kom.”


Jesus ask am di third time, “Simon, John pikin, yu sure sey yu love mi so?” Pita kon dey vex, bikos e pain am well-well, as Jesus ask am di same kweshon three times, “Yu sure sey yu love mi so?” Den Pita sey, “Oga God, yu know evritin, yu know sey I really love yu.” So, Jesus tell am, “Make yu feed my sheep.


I go kill all en shidren, den all di church pipol go know sey, I know wetin dey for pipol mind and heart. I go reward evribody akordin to wetin e do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ