Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mark 7:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Nor bi wetin enter inside pesin body go make am dirty for God eye, instead na wetin kom out from en mout, dey make am dirty.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mark 7:15
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make yu dey kareful about wetin yu dey tink, bikos na wetin yu tink for yor heart, yu go do.


Una, snake shidren! How una won take tok good word since una dey wiked? Na wetin full pesin heart, naim en mout dey tok.


Jesus ansa, “Afta evritin wey I don tok so, una nor still undastand?


Den Jesus koll di pipol again sey, “Evribody, listin to mi make una for undastand wetin I dey tok.


Anybody wey get ear, make e hear wetin I dey tok.”


E tell dem, “Una know sey di law nor allow us, wey bi Jew pipol, to visit Gentile pipol or follow dem do anytin, but God don show mi sey make I nor sey anybody nor dey klean.


Bikos God kingdom nor bi food and drink matter, but na about raitiousness, peace and joy wey di Holy Spirit dey give pipol.


Make una mind dey okay as una dey chop any meat wey dem dey sell for market.


Evritin dey pure to doz wey dia heart dey pure. But nor-tin dey pure to doz wey bad tins full dia mind.


Make una nor let difren-difren prishin wey una nor know turn una head. Una spiritual pawa dey kom from God grace, nor bi from food wey dem sakrifice, bikos di sakrifice nor fit help pipol wey dey do am.


To chop, drink and to do serimony take klean pesin body, na-im koncern dem. All dis one na rule for dis world, until di time wen God go bring di new law.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ