54 As dem kom down from di boat, pipol kon si sey na Jesus bi dat.
Doz wey dey loyal to Yu, dey trust Yu, bikos Yu nor dey leave doz wey wont make Yu help dem.
Afta Jesus and en disciples don cross di river, dem kon rish Gennesaret, den dem tie dia boat for der.
Di pipol run pass all di aria, karry di pipol wey nor well for mat go where dem hear sey Jesus dey.
Afta dis tin don happen, many pipol wey nor well for der kon still kom and e heal dem.
Wetin I wont na to know am and di pawa wey wake Christ from deat; to sofa wetin e sofa; to bi as e bi wen e die,