Wen Jesus hear wetin happen, e komot der enter boat kon go where pipol nor dey. But wen pipol from difren-difren town hear where e go, dem kon follow am.
Wen Jesus kom down from di boat, e si plenty pipol and e kon sorry for dem, bikos dem bi like animal wey nor get who dey look afta dem. So e kon tish dem many tins.