33 But many pipol si dem wen dem dey go, so di pipol kon run with leg from all di towns kon first Jesus and en disciples rish di place.
So only dem kon enter boat go one place where pipol nor dey.
Wen Jesus kom down from di boat, e si plenty pipol and e kon sorry for dem, bikos dem bi like animal wey nor get who dey look afta dem. So e kon tish dem many tins.
Plenty pipol follow am, bikos dem si wen e heal pipol wey nor well.
My brodas and sistas, make una undastand dis tins: Make una dey listin well-well and nor dey kwik tok or vex.