Wen Jesus hear wetin happen, e komot der enter boat kon go where pipol nor dey. But wen pipol from difren-difren town hear where e go, dem kon follow am.
But as di man dey go, e kon bigin shaut for evriwhere dey spread di story, sotey Jesus nor fit enter any town again, so e kon dey stay where pipol nor dey. But pipol still dey kom meet am from evriwhere.