17 Na Herod send men go arrest John put for prison, bikos of Herodias, en broda Filip wife wey e marry.
Naw, wen John hear for inside prison about di tins wey Jesus dey do, e kon send en disciples go ask am:
Wen Jesus hear sey dem don put John inside prison, e kon go back to Galilee.
But wen Herod hear am, e sey, “John wey I sey make dem kut en head komot, don wake-up from deat!”
Tiberius Caesar don dey rule for fifteen years wen Pontius Pilate bi govnor for Judea and Herod dey rule Galilee, en broda Filip dey rule Iturea and Trakonitis aria and Lysanias dey rule Abilene.
(For dis time, dem neva put John for prison).