16 But wen Herod hear am, e sey, “John wey I sey make dem kut en head komot, don wake-up from deat!”
Fear go katch dem and na di kind fear wey dem neva si or hear before. God go skata yor enemies bones. God go disgrace dem, bikos E don rijet dem.
so e kon tell en savants, “Dis na John di Baptist wey wake-up from deat! Naim make am get pawa to do all dis mirakle.”
kon sey, “I don sin as I sell dis innocent man make dem kill-am!” But dem sey, “How dat one take koncern us? Na yor business bi dat.”
Odas sey, “Na Elijah e bi.” Some kon sey, “E bi like one profet wey dey before.”
Na Herod send men go arrest John put for prison, bikos of Herodias, en broda Filip wife wey e marry.
Herod kon sey, “I orda make dem kut John head komot, but who bi dis one wey I dey hear all dis tins about so?” Bikos of dat, Herod kon try to find out more about Jesus.