13 Dem drive many demon komot from pipol body and pour oil for many pipol wey nor well head kon heal dem.
So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem.
Jesus koll di twelf disciples kon send dem two-by-two. E give dem pawa to drive evil spirits komot from pipol body.
Di seventy-two men kon kom back with happiness, dey sey, “Oga God, even demons dey obey us wen wi kommand dem with yor name!”