43 But Jesus warm dem well-well sey, make dem nor let anybody know wetin happen so, den e kon tell dem make dem give di pikin food chop.
As dem dey kom down from di mountin, Jesus warn dem sey, “Make una nor tell anybody dis vishon wey una si until God go wake Man Pikin from deat.”
Den, Jesus tell am, “Nor tell anybody, but go meet di priest, make e look yu. Afta, go give di ofrin wey Moses kommand to show sey yu don well.”
At wons, dia eyes kon open and dem kon bigin si. Jesus kon warn dem sey, “Make una nor tell anybody wetin happen so.”
So Jesus warn di man well-well as e dey go sey,
But Jesus warn dem well-well make dem nor let pipol know who e bi.
Di girl (wey bi twelf years dat time) kon get up at wons bigin waka round di house. Evribody sopraiz for wetin happen.
Jesus kon sey make dem nor tell anybody wetin happen. But dem kon dey tok am for evriwhere.
As dem dey kom down from di mountin, Jesus kon tell dem make dem nor tell anybody wetin dem si, until Man Pikin go don wake-up from deat.
E sidan for where dem dey chop; e take bread, bless am kon divide am give dem.
Jesus tell di man, “Make yu nor tell anybody, but go show yorsef to di priest and pay di ofrin wey Moses kommand sey, pipol wey dia leprosy don komot for dia body go bring, so dat di priest go know sey yu don really well.”
Di papa and mama sopraiz well-well, but Jesus kommand dem make dem nor tell anybody wetin happen.
“I nor like make pipol dey praiz mi,
Nor bi evribody si am, but na di ones wey God don choose, wey follow am chop and drink afta e don wake-up from deat.