37 Jesus nor let anybody follow am espect Pita, James and John, wey bi James broda.
Afta six days, Jesus take Pita, James and John (wey bi James broda), go on-top one high mountin.
E take Pita, James and John, wey bi Zebedee two shidren, with am. But bikos of wetin won happen, belle nor sweet am.
E take Pita, James and John follow body. E mind kon dey trobol am and e nor dey happy.
Afta six days, Jesus, Pita, James and John kon go one high mountin. E kon shange for dia front,
Wen dem rish di house, Jesus nor let anybody follow am enter, escept Pita, John and James with di pikin papa and mama.
But Pita drive all of dem go outside, den e knee down kon pray. E turn face di dead body kon sey, “Tabita, get up!” Naim di woman open en eye and wen e si Pita, e kon sidan.
Na di third time wey I dey kom visit una bi dis. If dem sey pesin do bad, two or three pipol must sey, na true, before pipol go bilive am.