33 Fear katch di woman wen e know wetin happen to am, so e kom meet Jesus, knee down for en front kon tell am evritin wey happen.
My Oga God, I dey kry to Yu for help and Yu don make mi well.
Kom! All of una wey dey loyal to God, make una listin as I dey tok wetin E do for mi!
Fear katch dem well-well and dem kon dey ask each oda, “Who dis man bi sef? Even breeze and river dey obey am!”
But e kon dey look evriwhere make e for si di pesin wey tosh am.
So Jesus tell am, “My pikin, yor faith don make yu well. Make peace follow yu and make yu well finish.”
As Zekaraya si di angel, fear katch am well-well and e kon dey shake.
But Mary dey fear, bikos of wetin di angel tok and e bigin wonder wetin di greetin mean.
Wen di woman si sey e nor go fit hide again, e kom out dey shake kon fall for Jesus front. For evribody present, e tok wetin make am tosh Jesus and how e kon well at wons.