Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mark 5:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Wen dem waka kom meet Jesus, dem kon si di man wey demon dey inside am before sidan for der, e wear klot and en head korrect, so fear katch dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mark 5:15
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den David kon dey fear God dat day so e kon sey, “How I go take karry di Kovenant Box naw?”


God ponish us, bikos una nor dey der to karry am for di first time and wi nor woship am as wi suppose to.”


Abi en pawa nor go make yu fear? Yu sure sey di fear nor go kill yu so?


So fear go katch dem, bikos God dey with di pipol wey dey obey am.


“How pesin go fit break enter strong man house kon tif en propaty, unless e first tie di strong man? Den, e go get shance tif wetin dey di house.


Yu tink sey, I nor fit koll my Papa sey make e send many angels kom help mi naw-naw?


So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem.


Wen Jesus don drive di demon komot, di man kon bigin tok. Di pipol wey gada for di place sopraiz well-well and dem kon sey, “Nobody don si dis kind tin for Israel before.”


So, di men wey dey guide di pigs for der, run go spread di news for di town and pipol for di aria kon go look wetin happen.


Pipol wey si wetin happen to di man wey get demon before kon tell odas wey kom.


As Jesus dey enter boat, di man wey get demon kon ask weda e fit follow am.


Bikos dem don tie en hand and leg many times with shain and handcuff, but e dey kut dem trowey. Nobody strong rish to hold am.


Jesus ask am, “Wetin bi yor name?” E ansa, “My name na ‘Legion,’ bikos wi plenty.”


Mary, wey bi Marta sista, sidan near Jesus leg dey listin to wetin e dey tish.


As Jesus kom down from di kenu, one man wey get demon for di town kom meet am. E don tey wen dis man wear klot or stay inside house, but e dey stay for beri groun.


E save us from darkness pawa and put us for di kingdom wey E give di pikin wey E love.


Bikos God nor give us di spirit wey go make us fear, but di spirit wey E give us, get pawa, love and sef kontrol.


Samuel kon do as God sey make e do. Wen e rish Betlehem, di eldas for di town dey fear to go meet am. So dem kon sey, “Hope yu kom with peace?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ