Just as apple tree dey among oda trees for forest, na so my love bi among di yong men. I dey like sidan for where e dey and en fruit dey sweet mi to chop.
So, great Zion, God hill wey dey holy, no evil or wahala go dey der again. Just as wota dey full sea, na so too God word go full pipol heart for di land.
Dem go bi like house wey pesin hide put bikos of heavy rain. Dem go bi like wota wey dey rush for desert; like big rock wey en shadow kover empty land.
and na on-top di mountin wey high pass for Israel. E go grow kon get branches; bear seed and e go bi very fine cedar. Difren birds go stay der kon build house put for di cedar tree.