24 Jesus kon tell dem, “Make una dey kareful for wetin una dey hear, bikos na wetin yu use take measure give oda pipol, na-im God go take measure for yu too and E go add join am.
My pipol, make una open una ear as una dey kom meet mi; make una kom meet mi and una go get life! I go give una kovenant wey go last forever kon give una di blessings wey I promise David.
So make una listin well-well, bikos pesin wey get, God go gi-am more, but pesin wey nor get, even di small one wey e tink sey e get, God go take am from en hand.”
I tell una true word, di time dey kom and e don even rish groun naw, wen doz wey don die go hear Man Pikin vois and wen dem hear am, dem go wake-up and dem nor go die again.
Dis Jew pipol get betta mind pass di ones wey dey for Tesalonika, bikos dem open mind take bilive di message and dem dey read God word evriday to shek weda all di tins wey dem hear, na true.
My friends, make una nor bilive evribody wey sey na God Spirit dey tok thru am. Una must test am to know weda na God Spirit e really get. Bikos many fake profets dey for dis world.